I don tire sef....ahn ahn...hw ppl go like tatafo reach dis level dt it wud bcme a national issue? :O infact d tin surprise me sotay I vex go do jumat for Ikorodu road.
To nack apako 4 d nail head, dis issue of we Nigerians famzing every international issue esp wen it has 2do wit America is "sadonic" and even "lugubrious" ( I have scattered sme ppls head wit grammar) No be me start am o,goan hold Hon Pat Obahiagbon lol.
Nywyz d issue here lies solely on d fact dt we Nigerians too dey famz....kai!!!
Oyinbo naturally dey famz ie on twitter nw, I see many Caucasians famzing @PiersMorgan or @JustinBeiber....at least we cn undastnd dt deze folks r influential in a way or mayb dem dey trip 4dem. Bt in Nigeria's case,na strange tins we dey famz,9ja ppl be famzing Hurricane.....SMH....
Lemme gve u an example,sm1s pm or tweet kud go like dis ---> "Hurricane Sandy hits Miami Beach at 175Km/ph",d 1st tin dt comes to my mind is "oya wetin make we do abt am now?" Sun don knack man pikin 4head,okada no dey,fuel dey stealth mode,salary no do man 4 d mnth nd u r here telling me abt hurricane.
Not dt I'm insensitive to d impact of d hurricane nd d lives affected,I jus wnt us to mind our own business cos in my own opinion,we have greater problems as a nation and no1 z sympathising wit us (so y we come dey drink panadol 4 anoda man's headache?).
Anoda dimension to it, is the level at wich Nigerians discuss intelligently in issues dt dnt concern us. Kai dis 1 z vry bad o,u wee see sm1 dt dsnt av common O'Level sayin tins dt me sef (an international relations graduate) neva hear abt America b4. Its baffling mehn, person go dey para like say Obama na him in-law...it is well.
Its d decidin nyt on Obama Vs Romney nd I cnt help but shake my head in utter disbelief as I see our young people carry on in d stead of our parents (ie putting d cart before d bull). Incase u dnt knw dis idiomatic expression,t means doing d wrong tin first.
Tell me! Is it Obama Vs Romney dt shud b our concern? Or d state of our ailing nation? Sadly,deze "familiar spirits" av nt only put dps and pms abt Obama nd his Victory,some went as far as sending BCs.....Gosh......I wz so angry (bt wetin man fit do?) Its our nature (our Nigerianism)
D worst tin z dt in sme circles,ts a sign of sophistication to dabble into issues dt dnt concern us (eg American issues) when our very own lies fallow. Let's face our problems nd stop famzin oda ppls own abeg.
Before any1 starts labelling me,I'd love to point out d fact that majority of us (Nigerians), always put our mouth in issues dt dnt concern us nd dis kud b seen in petty issues such as an argument btw a bus conductor and a passenger. And in more serious cases,our foreign policy eg Nigeria z gvin electricity to neighbouring African countries nd we neva do get light,imagine such?
I guess,its safe to say "poke-nosing" is a Nigerian thing.....abi u no get my grammar?
Game Plan: Let's try 2ensure we set our priorities right and face issues dt affect us as against tryin 2 put mouth in anoda persons yarn...if we kud mind our bizness,I believe tins wud b beta 4us.
No comments:
Post a Comment